Naija Sonnet 001
The love wey I get for you
dey so real and true
no let them pour sand for our garri,
if them like make them turn the air blue.
Na Baba God hand we dey
them no go fit touch us…
under him umbrella we go stay
you no need to kick up a fuss.
Even if you no trust am,
you no say I never fail,
and my God no be sham.
make you no act frail,
this ocean of love we go sail.
|